Duration 1:58

Barnz Agev GodNoGoShameUs RealTalkSeries

5 150 watched
0
336
Published 11 Jul 2020

God no go shame us is the first episode from the series "Real talk" Lyrics My guy make I tell you something God no go shame us Him no go even allow the hustle make e kill us Truth be say, this life no balance With all d hustle na zero still be the account balance This struggle dey real o I understand say plenty people dey depend on your success Some they trend ur matter as if you owe them like access Popsy dey sick, them they wait make you send cash Momsy dey house dey brag say him pikin go soon buy benz If you fail them go laugh you, You comut leave house so u go dey send something go house Every morning you dey pray make God no shame you, make him just bless this hustle Deep inside you dey wonder when the hustle go Me I believe say, God no go shame us Him dey see all our struggles That prayer wey momsy been pray for you , e be things o This thing na just time, God no go shame you But when God bless you, I hope say you sef no go shame God All our hope, na on God Me I believe say, God no go shame us, I dey pray say we sef, we no go shame God

Category

Show more

Comments - 25